Peller and Jarvis do am again! For last night live, Peller and Jarvis had another jealousy fight wey scatter TikTok. Fans were shouting for comment section, some dey cry, some dey laugh. WETIN HAPPEN? For the live, Peller was gisting with one female fan and Jarvis face change immediately. She vex, comot for live. Peller try to call her back but she no gree. For comment, people dey write "Na cruise" "No be cruise, Jarvis don tire" FANS REACTION • One fan talk: "This Peller and Jarvis na everyday fight, we don tire" • Another: "Na content, dem dey use us catch cruise" • Another: "Jarvis really love Peller, she dey jealous" MY OWN TAKE As I see am, Peller and Jarvis sabi how to hold TikTok. Every fight na more views. But true love dey inside too. Wetin you think? Real fight or cruise? Drop your opinion for comment.


Comments

Popular posts from this blog

Peller Gushes Over Wife Jarvis As She Shows Off Baby Bump At Salon

New Mum Stranded In Ekiti Hospital After Boyfriend Ran Away - Needs Help To Go Home